• Joke of the day

    Assuming you are watching football match at a
    viewing centre, Chelsea vs Man U.

    A guy just walked in and sat next to you and
    the following conversation ensue:

    D guy: Bros how far? Na match them dey play?

    You: Yes nau. Shebi na im u dey watch.

    D guy: Ok. Abeg who dey play?

    You: Na im be dat na. Chelsea vs Man U.

    D guy: oh ok. Abeg who wear blue?

    You: Na chelsea wear blue.

    D guy: owk who com wear red?

    You: oooh c am nau, na man u.

    D guy: owk no vex. Ehm bros na 1st half abi
    second half.

    You: chai guy na wa 4 u o. Na 1st half nau. C
    am, na 20minutes bros.

    D guy: oh ok. Bros abeg wetin be scores?

    You: come guy. Na 0-0 na. shebi na im we dey
    watch.

    D guy: oh oh oh ok 0-0. . Abeg who cum get
    zero?

    My broda my sista at dis juncture,. Wetin u go do??
    Sent from my BlackBerry wireless device.
    Call me on 081654
  • 0 comments:

    Post a Comment

    Flickr Images

    create with flickr badge.